Breaking News
Loading...
Friday 27 February 2015

Joke of the day

an initiative to bring some humor into your day, *winks*

E get one particular restaurant wey i dey go chop 4 G.R.A. E get one oyibo wey dey always come chop there too...
Anytime dis oyibo chop finish, he go shout ''Hey'', so I wonder wetin dey make am shout. I decided to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me sef go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I order wetin d man dey chop. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am finish, i no shout.
I collect extra plate, but i no still shout. I say dis oyibo na mumu o, wetin dey make am shout like dat? Na so i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d extra plate too na another N75,000.Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!!  heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy...........

Up till now, I still dey shout ....

0 comments:

Post a Comment

Quick Message
Press Esc to close
Copyright © 2013 SOCIALVILLA All Right Reserved